Donations are essential to keep Write Out Loud going    

OLD CHILDREN

entry picture

OLD CHILDREN

Oya choose!
E don reach our turn
Ben abi na Benz
Desk job abi na blowjob
Sweat pint abi sell pants 
Hustle Ikeja abi form Ikoyi
Na success abi na sex

Nothing new again!
Our old children get heart
Nor gree sleep cot
Use Belle face shortcut
Follow friends begin join cult 
Carry cutlass start to cut
Begin claim Innocent for court 

Old children take time!
Who one buy Benz, work!
If u dey donate blowjob, go marry!
If you one sell pant, open boutique!
Who one stay Ikoyi, hustle!
E go soon shock una
For d kind tin wey una go harvest

©Kporho Vwede Daniel 
+2347067333949
Ig: General_Ali_official

All rights reserved.

◄ COLD BEGINNING

RESOLUTION ►

Comments

No comments posted yet.

If you wish to post a comment you must login.

This site uses cookies. By continuing to browse, you are agreeing to our use of cookies.

Find out more Hide this message